| B4b4 vice presido Alex Ekwueme don look Chukwuma Soludo from head to toe. |
|
|
|
|
B4b4 vice presido Alex Ekwueme don look Chukwuma Soludo from head to toe as fine boy no pimples nor craw craw no enzyme and na him be d main bros wey fit dis country,him talk dis 4 governorship election inside Anambra state,Chief Ekwueme say him support d prof bcos d guy dey see better vision to take d state develop wella. On top prof mata,prof soludo,omo d bros don para infact he remain make him cry 4 d level wey yamayama and poverty dey 4 state especially rural areas and to stop yamayama and poverty follow for him campaign waka wey him see vision for. Adamawa judicial staff union of naija dem don finally stop d 2mth strike with immediate effect ,state secretary of d union na him sign dis wan and secretary to state government and state chief jugde Aris kobis and justice Bamare Bansi and Governor Murtala Nyako don promise say state government go solve any gbege wey go come up and d wan wey dey ground. India don carry waka on top to take get hand inside Africa Economy dem don put hand inside paper with people wey dey do oil 4 Angola and Nigeria on top dis kin waka China don waka tay leave india 4 back. Libya appeal court don change mouth on top 16 month jail wey dem give swiss bussness man wey stay pass time wey dey give am visa. Rachid Hamdani wey dem being think say dey stay Swiss Embassy 4 Tropoli nor dey wen dem do him own court mata with d Swiss bussman 4 December. Dem say dis be like plan work as for wetin happen 4 july 2008 wey dem arrest Muaammar Gaddafi pickin Geneva. |
















