| We govt don talk say dem go punish anybodi dem find wey say get hand in d Jos palava |
|
|
|
|
We vice presido Goodluck don hala say make we olopa find who go kpai oga Dipo Dina. We ogbonge government don talk say dem go punish anybodi dem find we say get hand in d Jos palava. Prime minister Sadiq al-Mahdi wey dem comot don enter election. Dem help one man 4 Haiti after 2 weks wey ground shake. Vice presido Goodluck don hala 4 police make dem find and hold d people wey kapai AC governor somebodi 4 2007 wey dem kaput 4 ogun state Dipo Dina kiakia,na d paper him release by him talk talk somebodi.Ima Niboro.Him hala say him no like am and dem must find who do am kiakia. Meanwilly b4b4 governor 4 lagos Bola Tinubu,hala say if all dis kaputing of people dey go soo e no good 4 we poliki,Chief Tinubu talk am when him go greet Dipo Dina family him say dis kin tin go fear young young people to do poliki. Oga speaker sef say him shock when he hear say dem kaput oga Dina,He say dem make we big iroko tree just fall like dat when him star just dey shine.Him come beg we olopa to do sometin to find who kapai am e don dey to much 4 naija now. Vice presido Goodluck Jonathan donn wey don hala say we ogbonge government go hold and punish anybodi wey get hand in d jos palava him waka go jos to see how tins take be and him say government don start to put tins 4 ground wey no go let dat kin tin happen again,Him talk wit people wey dem scata dem home 4 police college 4 jos. B4 dis talk,Governor Jonah Jang don beg we ogbonge government to punish all d people wey cause palava 4 jos,Him say dem no do d people wey cause palava anytin 4 2008 and make dis one no be de say tin,he beg people wey be jos people,moslems,chirstians and visitors to try get peace 4 bodi. Dem say after 5 hours of talk talk behind lock door yesterday,Senate no se way to go ontop dis we presido wey no dey becos of sickness,but dem don promise to do sometin last Thursday wit Ahmed Yayale say dem go do sometin.chairman 4 senate ontop media talk Ayogu Eze talk say dem go continue d talk today becos every senator neva finish. Minister 4 Aeroplane mata Babatunde Ometoba hala say people wey wan enter plane wey dem no gree 4 machine to check dem,make dem no fly 4 plane.Mr omotoba say minister or government people,everybodi must do checking or make dem no enter plane,him dey talk becos people dey hala say d machine dey disturb dem. Foreign matterB4b4 prime minister 4 sudan Sadiq al-Nahdi don say him go enter election against the person wey dey now Omar al-Bashir 4 d election wey dey come.Mr Mahdi being don dey dat seat 4 1986 but Mr Bashir use army gbege comot am 4 1989. Dey don comot one man wey never die 4 one coro 4 haiti after 2 weeks wey ground shake 4 dere and dey don carry am go hospital. sportsDey don tell Lagos state government make dem build oda place wey people fit dey go shake bodi and oda tins 4 school wey we young people fit d use learn sports tin. The Chairman 4 organise, we state lawn tennis club anniversary talk 4 their 115 years anniversary, Muyiwa Omisade say tennis don d small small dey comot 4 naija. |
















