| INEC go start d plans 4 2011 election 4 march dis year |
|
|
|
|
INEC go start d plans 4 2011 election 4 march dis year. Minister 4 power Lanre Babalola,don promise naija say we go get light. Ethiopia plane don fall 4 water 4 Beirut. Haiti people wey kaput 4 d ground wey shake pass 150,000. People just dey hala 4 b4b4 presido Olusegun Obasanjo 4 d talk him talk on top presido Umaru Yar’Adua bodi mata,say make him behave well and drop him I no work again paper,PDP hala say wetin in talk no good and him just wan cover him badness. Meanwilly AC talk say na half truth him talk dem say na him force presido Yar’Adua enter PDP and na him rig 2007 election 4 am. Meanwilly chairman senate people wey dey torchlight media Ayogu Eze don para say all d people wey dey talk say people 4 senate collect money make dey fit put vice presido Goodluck 4 we presido seat make d comot now talk or close their mouth 4ever. Him say make all d people wey get mouth no fall 4 dis kin talk so dat people go tink say dem corrupt.
Anyway dem say d 6 people wey go go Saudi dis week,House don talk dem name last week say dem go go greet am and see how him bodi take be.na Deputy oga 4 house Baba Shehu Agaie go sidon 4 chairman oga Mohammed Ndume,of ANPP sef dey dere. Chairman of INEC Maurice Iwu say dey go start plan 4 d 2011 election 4 march dis year,Him say notin go change even if we election change Iwu say dem don get plan how to do d election 4 Anambra wey magomago no go dey. Meanwilly we ogbouge government don talk say make dem get d people wey go dey do beta 4 we election law 4 naija oga lawyer Tokumbo Odutola talk 4 we program,naija watch say na feb 6 election 4 Anambra go show wetin go happen 4 2011 election,Barr,Odutola say make young people no gree make dem tief ballot. Oga minister 4 power have Babalola say make naija relax we go celebrate 50 years.Him say dem no wetin dem work be and we go try to celebrate we 50 years wit beta light,him say na mata worry dem,dem 4 don give us 6,000 mega 4 December.
|

















