Coolfm and Wazobia T-shirts

Sticker for T shirt ( when presenter says Sticker for T shirt call us and tell us you have the new combined cool wazobia sticker and we will deliver to you a T shirt after verification).

Search

Custom Search

Naija's Top 9


1.
P SQUARE
DANGER

2.
WANDE COAL
I KNOW YOU WANT IT

3.
BRACKET
YORI YORI

4.
AY-COM FT TERRY G
PASS ME YOUR LOVE

  View all Top 10

Schedule! Who's on the air at what time? It's all here!

Who's Online

We have 315 guests and 22 members online

Visitors Counter

mod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_counter
mod_vvisit_counterToday2620
mod_vvisit_counterYesterday2341
mod_vvisit_counterThis week12351
mod_vvisit_counterLast week12889
mod_vvisit_counterThis month7389
mod_vvisit_counterLast month58632
mod_vvisit_counterAll831882

Online (20 minutes ago): 122
LIVE Streaming!
HEADLINES PDF Print E-mail
The Oga wei dey renge the forgiveness and peace matta, Lucky Ararile say na 15,000 I no gree boys for Niger Delta na them drop them gun.

We Vice President Goodluck Jonathan don tell young people for Nigeria say make them commot them hand for wuruwuru.

Africa people don say them want stop the gbege wei dey for Darfur for Sudan.

People wei dey renge security matta for UN don say them go add more time for the soldiers wei them send Afghanistan.

Torey Proper We oga President, Umar Yar’Adua don tell Taraba people say them go start to renge mambila light matta. He say Taraba State get something well, well and them go use am make the people them life better. Oga Yar’Adua say them go renge Mambila light matta and other thing wei go make the people life foe Taraba state to better.

Taraba state Governor, Danbaba Suntai don say na some of the big people wei dey do politics for them state na them dey cause all the gbege wei dey shele for them state. Na for where he dey talk to one talk, talk person yesterday for Abuja na him he say, na the big people for them state na them dey spoil people belle for him government and he say he don tell oga Yar’Adua about the matta.

We vice President, Oga Goodluck Jonathan don tell all the young, young people for Nigeria say make them commot them hand for wuruwuru because e dey carry bad name give we obodo Nigeria and e dey also spoil the better work wei the good young people dey do. Oga Jonathan still say Nigeria dey bright well, well because plenty of we young people get better, better hand work wei God take bless them.

Yesterday for Abuja, the people wei dey make law them don dey find way wei them go take stop the wahala wei one river for Cameroon wan cause, the name of the river na Lake Nyos. One Oga wei him name be Joseph Akaagerger say this river dey near one place for Nigeria for north side and he go fit cause sickness and wahala for ground. Oga Joseph say this big river don tumble before, oyibo people dey call am volcanic eruption and 1,700 people na them caput and plenty people wounjor well, well.

Oga wei dey renge forgiveness and peace matta for Niger Delta, Lucky Ararile say na 15,000 I no gree boys for Niger Delta na them carry them hand for say them no go fight again and 5,000 things wei them dey use fight and 18 gun boat naim this people carry give government people. Oga Ararile say na 8,299 I no gree boys na them don drop them gun since August but he say them go plenty pass this one because when they announce the last day, plenty of them been rush to drop them gun and we oga President go meet the oga of this I no gree boys for Abuja today.

We ogboge government and people wei dey fight for Niger Delta people them write make them begin talk before the date wei give this I no gree boys to stop the wahala wei them dey do for where them dey put oil. Oga wei renge public matta for PDP people Wale Ahmed, since government don dey renge for Niger Delta, E for good make them settle all the wahala wei dey Niger Delta. Mr. Ahmed tell one of our talk, talk person Ijeoma Okoye say we need peace for Niger Delta so that Nigeria sef go dey cole, cole.

Lagos State Governor Babatunde Fashola don say make Local Government people join hand with companies them to renge them area well because naim go make the economic matta to waka well. Oga Fashola people go enjoy all the better wei dey for government if them self put hand and renge things well.

The big oga for AC wei stand to be Governor for the election wei them do for 25 o0f April for this year for Ekiti state Kayode Fayemi, them say yesterday, he don end the case wei he carry go court for election matta, He say make the court people announce say na him win the election. Dr Fayemi say na the number of the people wei vote for am naim plenty pass, so make them announce say na him win.

Africa people, them don finish all the plan wei them dey do to see say all the gbege wei dey shele for Sudan go stop. Na before, before South Africa President Thabo Mbeki na him be the oga of the people wei renge this plan and them don carry the report go give Africa people