
Some of we big big people inside we country yesterday for the sit down talk wey dem do yan say na something wey go make sense well well for us as country if we go fit range beta National sit down talk wey e be say somebody from every language go sit down, yan for him people make we allfor know where our problem dey, and how e be and how we go talk range dem.
Person wey dey talk for dis sit down talk wey dem do yesterday, Pat Utomi yan say for him o, time don reach wey we go do dis National sit down talk, dat na National Sovereign Conference, especially the wey wey things take dey go for we country, we gast do sit down talk make things for beta pass as e be now.

Meanwhile one of we kajad bros, Edwin Clark yan say for him o, if we fit range take settle dis mata of share share of money take wey e be say federal government go get dem own, state and Local Government go get dem own if we fit range am in a way e be say one person no go dey squeeze face like person wey dey butu becos of say him feel say dem dey cheat am, if we fit settle dis mata country.
Oga Clark still say for him own church mind dat mata of say people dey march dey vex say soldier bin dey inside Lagos det time, dey do we no go gree we no go gree him wey be Edwin Clark , him no support am becos him no feel say e mwke sence at all, at all.

Still on top we country mata, we before before Minister wey dey chook eye on top Aero plane fly fly mata, Femi Falani Kayode yan say look for him o, him believe say any need no dey for we federal government to yan do sit down talk with Boko Haram people.
And say bone mata, him no go hide mouth, na some of we big big political guys na im dey sponsor boko haram.